God’s Name Can Never Be Mocked
Daniel choose to give God komplit attention, and hin action infuriated hin enemies. Fo dis reason, dem plot to kill am. The bible report am,
“So di governors and satraps plan to find some charge against Daniel concerning di kingdom; but dem no fit find charge or fault, because he dey faithful; and because sey dem no find any error or fault in am. Then these men say, “We no fit charge any error against di Daniel unless we find am against am koncerning di law of hin God” (Daniel 6 4-5). Daniel enemy get chance to successfully cast am to di lion den, but God defend hin servant. God shut di lion dem mouths, and dem no fit hurt am. Konsequentially, Daniel opponents land inside di lions den, and di animals chop all dem. E dey reported, "(The king say) I make a decree say fo every dominion of my kingdom men must tremble and fear before di God of Daniel. Fo Hin be di living God, and steadfast forever; Hin kingdom na di one weh no go fit destroy, and Hin dominion go endure to di end. He deliver and rescue, And He work signs and wonders fo heaven and fo earth, who don deliver Daniel from lions pawa(Daniel 6:26-27).
LESSON:
God go defend Hin pipu, and He no go allow di enemies to mock Hin name in dea lives. Wen we (believers) act fo faith, God dey glorified! Fo dis reason, we must stay with our konfession of faith, and practice kristianity fo di way weh go glorify Krist. Once we make God happy as we dey demonstrate unwavering faith, He go honor us in return. However, kommon fact about kristianity remain di same: Believers go face challenges fo dis present world. Satan and hin forces go attempt anything to stop believer from trusting God.
However, faithful sons and daughters of God must msintain to remain committed to Krist - Di Savior. Di mixture of good and evil that we fit face in this world are temporal. Dem go soon become things of di past. Believers in Jesus Krist must dey kourageous always, since we know sey our present afflictions na just fo short time. Time of redemption dey on di way, and Krist go move us from this evil world to a perfect one - where no form of evil go fit exist. Believers must dey expect di second coming of Jesus Krist, and dey prepare always!
PRAYER:
Dear God, I beg give me strength to remain committed to my konfession of faith inside you. Help me to stand strong against any opposition weh fit challenge my belief. Let your Holy Spirit empawa me to stand firm fo faith so that devil go be put to shame, and your name go be glorify. Assist me to make i remain fit fo your second coming, so that i fit be partaker of your benefits fo heaven. I beg keep me fit now and always! Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
