God Will See You Through
God wonder fit easily account fo inside David life. He hail from kommon family fo small town, and he hold no significant position among hin siblings; yet God get special plan fo hin life. Di Kreator raise David from very low position to high level. He make am prevail over hin life battles and crown am as di right king of Israel. Di bible testify,
“...So David go on and become great, and Di Lord of hosts dey with am” (1 Chronicles 11:9).
LESSON:
God no dey lie, and He no go change Hin position towards Hin pikin dem. He go
fulfill anything weh He don promise dem - under any kondition. Although life battle fit dey tough and di going fit dey tough, but God pikin dem go quick get victory. Since God never kompromise promise, He no go change Hin mind, but He go stand by Hin word to see Hin pikin dem to dey share testimony.
PRAYER:
Dear God, i beg declare your promise of goodness onto my life. I know sey your promise dey sure, and dem go come to pass. Therefore, I ask sey make you please declare to my life good health, long life, and prosperity. I beg help me to enjoy all your goodness from now and always. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
