God Will Not Allow Devil To Prevail Against You
Enemy mock Israelites, and dem ask dem to sing dea melodious Zion songs inside foreign land, but di Israelites refuse. Instead, Israelites lamented in protest as e dey reported,
“By di river of Babylon, dea we sit down, yes, we cry wen we remember Zion. We hang out harps ontop di willows in di midst of am. Fo dea those weh carry us away fo captive dey ask us fo song, and those weh plunder us request mirth, say, “Sing one of una Zion song fo us!” How we go sing Lord song fo foreign land?” (Psalm 137:1-4).
LESSON:
Satan and hin forces love to mock God pikin during distress. Di enemy don field di day weh one kristian go fall to dea trap, and dem go dey quick to persecute, condemn, and ridicule him or her. However, God care fo Hin pikin, and He no go allow Satan (and hin evil elements) to prevail over dem. God go help Hin pikin dem to rise above dea challenges; He go restore dem from dea pitfall, and e go help dem to come to a renew relationship with Am. Di kreator go forgive and restore Hin pikin dem to Hin true love. However, God pikin nobi losers, but Satan and hin own forces bi di losers! While di enemy fit enjoy small victory over one kristian weh fall from grace,dem get eternal kondemnation to suffer. Satan (weh no get repentance and forgiveness opportunity ) go spend hin eternal life in hell fire – and hin attaché go follow suit to di same location. Jesus’ followers go remain fo heaven to enjoy Hin everlasting benefits!
PRAYER:
Praise God I bi God pikin! Praise God, I bi redeemed person from di Lord! Na my choice to sing God songs, and hin praises go ever remain fo my mouth. Satan don loose hin battle ontop my life. I go neither sing nor dance before Am again. My total life dey kommitted to God, and Hin praises gol ever remain fo my mouth, I go praise God from now and ever more. Thanks to Oga Jesus Krist weh turned me to God! Amen
