God Will Deliver You
Babylon nation don oppressed Israel fo long, but God say E don determine to stop dem. God talk am through Jeremiah,
“Because e go come to pass fo that day,’ Di Lord of hosts talk am, ‘Say I go break hin yoke from your neck, and i go burst your bond; foreigners no go enslave dem again. But dem go serve di Lord dea God, and David dea king, who I go raise up fo dem” (Jeremiah 30:8-9).
LESSON:
God go ever keep Hin pikin dem fo mind; E go remember Hin love fo dem, and He go forgive dea sins. Di kreator go deliver Hin pikin dem from any form of affliction weh Satan fit don impose on dem. Since Hin name nah Jehovah Nissi, He go do whatever necessary to defend Hin pikin dem. Hence, e make sense fo anyone to associate him/ herself with God and become Hin pikin. All e take to become God pikin nah tin weh dey very simple: Pesin must konfess Jesus Krist as di true God pikin, and must accept Am as his/her Lord and personal Savior. Once Krist take over such pesin, he go automatically konfirm him/her as God pikin - weh deserve overwhelming protection and blessing!
PRAYER:
Dear God, I know sey you bi di Almighty God weh get pawa to do all things. You
go do whatever necessary to protect di interest of your pikin. Fo dis reason, I give my life to you today; I dedicate my life to become your pikin. I konfess say Jesus Krist nah your true and only Son send to save di world, and I accept Am to my life as my personal Lord and Savior. I beg write my name inside book of life, and make me start to dey enjoy your benefits of provision and protections from now on! Fo in Ogq Jesus Krist - your Son - I make my requests. Amen.
