God Will Accept Anyone That Turns To Him
Exile Jews weh return to Jerusalem (dea homeland) also renew dea covenant with God. Dem promised to follow God rule fo marriage, and dem also promise to obey hin requirement to keep di Sabbath Day holy. Di pipu say, “if di pipu weh dey di land bring ware or any grain to sell fo Sabbath day, we no go buy am from dem fo Sabbath, or on holy day; and we go forego di seventh year produce and di exacting of every debt” (Nehemiah 10:31).
LESSON
God dey will to work with any Kristian weh is determine to serve am well. He go also work with a backslidden kristian weh choose to repent from hin sin. Jehovah go accept one repentant sinner fo a way weh dey similar to di story of di Prodigal Son in inside bible (Luke 15:11-32). A pesin weh repents from hin sins, and serve God well go be kondemned on God day of judgment. Di person go find hin place with God in heaven.
PRAYER
Dear God, i beg give me a heart weh follows your instructions. Help me to humbly repent from my sins and turn a new leaf so that i fit qualify fo your kingdom. Forgive my past sins and guide me to startto dey live new life of holiness before you. I beg make my ways satisfy you on earth so that i fit qualify fo your eternal kingdom. Fo in Oga Jesus Krist i make my requests. Amen.
