God Or Idol?
We Christians no dey serve god wey we no know, but we dey serve god wey dey for heaven kon reign in eart. Di skripture talk am,
“Why Yu dey let di nashons sey, “Where dia God dey?” Awa God dey for heaven And E dey do wetin E like. Na silva and gold human being take make dia juju.Di juju dem get mout, but dem nor fit tok; dem get eye, but dem nor dey si. Dem get ear, but dem nor dey hear, dem even get nose, but dem nor fit smell anytin. Dem get hand, but dem nor fit tosh or feel anytin. Yes! Dem still get leg, but dem nor fit waka. Dem even get trot, but dem nor fit klear am or make any sound. Pipol wey dey make juju and all doz wey trust dem and di juju, Bi like di juju wey dem make with dia own hand.” (Psalm 115:2-8).
Lesson:
Oga God rejects idol worship, and na foolishness patapata for anyone to dey serve idol. Howeva, wat benefit can pesin see to dey woship idol? Notin! He good make pipol serve di living God, dan to dey serve god wey no dey talk. Di living God na di only one wey kreate all di world and dey reign in di mata of mankind; so, trusting him go bring plenti gain. Di kreator go bless pipol wey put all dia trust in him, but he go reject and ponish dose wey dey woship idols – onless say dem repent.
Prayer:
Oga God, abeg help me to serve you evritime witout say anitin go disturb me, and let me faithfully give my praises and prayers to you evritime. Help me to remain konsistent wit you all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
