God Is Merciful
God expressed Hin fatherly love towards di outcast Israelites - weh don heavily pay fo dea disobedience. The kreator go light Israelite burdens and restore dem from captivity to dea homeland. God tell Ezekiel about Israelites,
“Therefore say, ‘Di Lord God talk am: “Although I don cast dem far away among di Gentiles, and although I don scatter dem among di countries, yet I go be a little sanctuary fo dem fo di countries weh dem don go.”’ Therefore say, ‘Wetin di Lord God talk bi dis: “I go gather you from di pipu, assemble you from di countries wea una don scatter, and i go give you di land of Israel.”’ And dem go go dea, and dem go kommot all hin detestable things and all di abominations from dea. Den I go give dem one heart, and I go put new spirit within dem, and kommot di stony heart kommot from dea flesh, and I go give dem heart weh be fo flesh” (Ezekiel 11:16-19).
LESSON:
God dey gracious and merciful; He no go cast sinners off forever, but He go restore dem back into Hin true love. Despite di magnitude of evil weh humans don kommitted, Jehovah still choose to create redemptive pathway fo us! God understands sey we be humans kreate kommot from dust and we dey far from perfection; therefore, He go work with us until we don fully dey redeemed. Jehovah go forgive our sins and restore us into Hin perfect love. To achieve this, Hin send Hin only begotten Son Jesus Krist to earth to kome save di world. Krist go die fo sins of humanity and reconcile us to our kreator! Indeed, Krist achieve this purpose; hence, humanity must express dea faith in Am to be saved. Anyone seeking redemption from sins must konfess Jesus krist as God only divine Son, and accept Am as hin or her personal Lord and Savior.
PRAYER:
Dear God, I understand sey i be stinking sinner weh no deserve anything good from you! However, I humbly come before you today to ask fo forgiveness. I beg forgive my sins, and clean me from my unrighteousness. Grant me redemption and restoration through my faith inside your Pikin Jesus Krist. I declare my faith inside Jesus Krist, and i accept Am as my personal Lord and Savior. I beg write my name fo di book of life, and count me worthy make i partake in your eternal kingdom. Fo in Oga Jesus Krist name I make my requests. Amen.
