Do Not Give Up During Trials
Sometimes people dey misunderstand God servants , abuse, and judge; however, di Kreator go reward any servant weh give all e take to remain faithful to di end. Paul, God servant, share hin experience of world abuse and hin loyal kommitment to God. Paul talk am,
“Fo I think sey God don display us, di apostle, last, as men kondemn to death; fo dem don make us spectacle to di world, both to angels and to men. We bi fool fo Krist sake, but you dey wise in Krist! We dey weak, but we dey strong! You are distinguished, but we dey dishonored! To di present hour we both hunger and thirst, and we dey poor clothed, and beaten, and homeless. And we labor,
work with our own hand. Being reviled, we bless; being persecuted, we endure; being defame, we entreat. He don make us di filth of di world, di offscouring of all things until now” (1 Cor. 4:9-13).
LESSON:
God servant often face criticisms of others; dem dey persecute dem and subject dem to hash criticisms. However, Jehovah go reward Hin servants weh remain unwavering during trial. He go assist dem on earth, and honor dem fo heaven also. Therefore, everyone weh serve God fo any capacity must understand sey hin or her efforts no dey in vain. Pipu weh suffer persecution and remain kommitted to God go enjoy hin benefits! Di kreator go glorify Hin name fo dea lives so that all pipu (including unbelievers) fit witness Hin demonstrative pawa, grace, and salvation.
PRAYER:
Dear God, I beg you to please make me be faithful servant weh go remain loyal to you always. I also pray fo your other servants throughout di world. I beg give everyone courage and strength to serve you well well. Give us pawa to konsider serving you as our prime goal. Make your servants efforts bear fruits fo your kingdom; make our various efforts lead to salvation of souls, so that devil fir dey ashame and your name go be praise. Fo in Jesus Krist name i make my requests. Amen.
