Disobedience Dey Lead To Sofferin
King Ahab get a big palace, but he dey jealous of Naboth wey get small garden. Di king we no dey okay wit wetin he get, wey dey greedy join hin wife (Jezebel) to kill Naboth. Di skripture tok say, “.E get one vineyard wey dey near King Ahab palis fo Jezrel and na Nabot get am. One day, Ahab tell Nabot, “Make you give mi your vineyard wey dey near my palis, bikos I won use di land take do vegitabol farm. I go give you anoda vineyard or pay you betta prize fo dis one.” Nabot ansa, “I inherit dis vineyard from my grand-grand papa. God forbid sey I go give or sell am to you!” King Ahab kon dey vex and e nor happy with wetin Nabot tell am. E liedan face di wall fo en bed and e nor gri chop. Jezebel en wife go ask am, “Why you dey vex like dis? Why you nor gri chop?...."Den Jezebel rite leta, sign am with Ahab name, use en seal take seal am kon send am go give di ofisas and doz wey bi leaders fo Jezrel. Di leta sey, “Make una kwik-kwik gada di pipu make dem fast and pray den make Nabot dea leader. 10 Make una arrange two thief make dem akuiz am sey, e curse God and di king. Den take am komot fo di town kon stone am die.” (1 Kings 21:1-4,8).
LESSON
To dey do wiked dey evil and God go ponish it. Di kreator go ponish di wiked pipu, no mata how pawaful or how big dem be. Onless say dem repent, a wiked pesin go end up fo hell fire – where dere go live life wey no dey finish ponishment. Howeva, di word “wikedness” dem no dey write am on pesin forehead; most wiked pipu no dey know di pesin dem be onless dey don sheck diasef well-well. So, he dey impotant make pipu check demsef before dey do anitin. Evribodi must to dey sure if dey don konklude whether dey don dey do some wiked aktivities wey dem must to leave. Oga God sabi show love and he dey quick forgive, he go forgive kin give pesin wey repent from hin wikedness second chance.
PRAYER
Oga God, please forgive me of any wicked act weh I don involved myself. I am sorry fo every evil act weh I don commit. I repent from all my wikedness today, and I no go return to dem again! I do talk say I go dey do tins di right way. I go dey show konfam judgement wey no get mago-mago, I no go go back to dem again. I don talk say I go dey do tins.I no go use pawa ova anybodi fo my own gain; I go treat pipu wey dey onda me well. I go dey okay wit anitin wey I get, and I no go dey jealous of odas. Help me to dey honest wit you and oda pipu, so dat he go dey well wit me fo all di days of my lifetime Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
