Di Return of Oga Jesus
Oga Jesus krist kompared his second coming to Noah time: All tins dey go fine, so pipu no listen to God warning wey bi of repentance and obedience.
Unfortunately, God kon destroy all pipu - kon leave only Noah family. Flood kova di eart,and all pipu die! Oha Jesus talk say"As e bi fo Noah time, na so e go still bi fo Man Pikin time. Dat time, pipu dey chop and drink, even fo di day wen Noah enter di ark, men and women still dey marry, until wota kon distroy all of dem.
“Na so e still bi fo Lot time, pipu dey chop and drink, dey buy and sell, dey plant and build house; but di day wen Lot komot from Sodom, fire and sulfur fall like rain from heaven kon kill all of dem. Na so e go bi fo di day wen Man Pikin go show ensef.” (Luke 17:26-30).
LESSON
Oga Jesus Krist go return to di eart wen pipu no expect: he go carry di saints to heaven, but he go porsu di unbelievers go hell fire. Dose wey dey behind go dey live at di mercy of Satan (The kreature wey wicked pass) Satan - who we dey kol devil go sofa sinas fo hell. However, at di same time, dose wey oga Jesus krist don come carry go remain wit him fo heaven so dem go dey enjoy peace wey no get end.
All pipu must to declare dea faith in oga Jesus krist - so dem go fit folow him go. Oga Jesus krist na di only pesin wey go fit beg fo sinas on God Last Day Of Judgement! Oga Jesus krist wey die fo sinas go beg fo pipu wey believe him,and he go komot dem from di punishment of hell. Di savior go declare hin saints "Justified". However,he no go allow di unbelievers make dem enta heaven.
PRAYER FOR SALVATION
Oga Lord Jesus krist, abeg i won go to heaven - i no won go to hell fire. Now, i give my life to you today. I konfess you as Lord, and i accept say you bi my personal Lord and savior. I deklare say from today, i go dey serve u well-well, and i go folow you fo di rest of my life.
Since i don pray, i deklare mysef say i bi pikin of God; my name don dey fo di book of life, and heaven bi my final bus-stop. Praise God.
