Di High Priest
Di priest of Oga God na pipu of high standard wey play konfam roles in di lives of pipu. All di priest of Oga God must to dey respected, but one prince dey wey pass oda prince Hin rank. Hin name be Oga Jesus Krist:thru Am pipu dey receive forgiveness of dea sins, kon get permanent solutions to di problems. Di bible talk am,
“Seeing then weh we get great High Priest weh don pass through di heavens, Jesus God pikin, make us hold fast our konfession. Because we no get High Priest weh no fit sympathize with our weakness, but e dey tempted in all point as we, yet as e no get sin. Let us therefore come boldly to throne of grace, so that we go fit obtain mercy and find grace to help fo need time” (Hebrews 4:14-16).
LESSON:
Jesus Krist bi di most high priest of all time. His priesthood roles dey greater pass any other. Hin offer Himself as sacrificial lamb fo our sin; Hin plead fo our sin, and reconcile us back to God. (Indeed our sin don turn us to fugitive, but Krist reconcile us back to God). Krist no only work on redemption of our souls, He also take di responsibility of establishing new earth and new heaven to host us after di present one stop to exist. Since Jesus Krist get all e take to live a komplete and a fulfil life now and in future, all pipu suppose konsider accepting Hin salvation invitation. Everyone suppose konfess Am as God only Son send to save di world (John 3:16). Everyone must konfess Jesus Krist as Lord in order to be save!
PRAYER:
Oga Jesus Krist, I know sey you be di most high priest of Oga God wey fit bring any pesin to God. You sakrifice your life humanity so dat dem go dey save. I bilive say you be di Savior of di world, and i personally konfes you as my Lord and Savior. I give all my komplete life to you today, and i go kontinue dey serve you all di days of my life. Abeg give me all e go take to faithfully serve you to di end. Na fo your name Oga Jesus Krist i make my konfesan of salvason.
