Di Gospel Dey Unstoppable
Anti-gospel pipu kill Stephen bekos of hin faith in Oga Jesus Krist. Dey throw stone to di preacher ontil he die. Howeva, before he die, Stephen don see a vision and he see Oga Jesus Krist dey praise am for the faith wey he get in him. Di man share hin experience wit di pipu wey wan kill am sat: “Look! I si heaven wey open and I si Jesus Christ, God Pikin, stand for en rite hand.” (Acts 7:56)
LESSON
Anybodi wey sofa for di sake of gospel go see plenti rewods from God. Di savants of God fot taste some rewods on eart, but no eartly rewods fit dey kompare to di heavenly rewords. Anybodi wey sofa for di sake of Krist go be King for heaven. Di savants of God go dey specially dekorated for heaven, and di glory of God go shine for all di provinces of heaven.
PRAYER
Oga Jesus Krist, abeg anoint me wit grace to dey preach di gospel wey dey impotant. Kon inkrease my faith to stand gidigba wit the worl of evangelism. Help me to dey preach yur gospel witout fear and for evritym. Abeg help me to be yur true ambassador, and let me bring plenti rewods to yur kindom. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
