DI BELIEVE WEY YOU GET FIT CHANGE ANY TIN
You go get some kain power from God if you fit dey read di bible. A woman wey no well fo some years get healing wen she don zero her mind say she still fit get am. She dabaru di law wey bi fo di jews so she go fit touch oga Jesus cloth so she go fit dey free from di sickness. Di sickness wey dey worri di woman komot as di woman do wetin she dey tink for her mind.
Di skripture talk am say "Wen Jesus go back fo di oda side fo di river, pipu welkom am fo dea, bikos e don tey wey dem dey wait fo am,den Jairus wey bi oga fo di sinagog waka kom. e fall for groun near Jesus leg, dey beg am make e kom en house, bikos e only dota wey don rish twelf years, dey die. As Jesus dey go di man house, pipol kon dey waka jam am anyhow bikos dem plenty. One woman dey among dem wey don dey mestrate for twelf years naw, bikos nobody fit heal am e waka kom Jesus back kon tosh Jesus klot korna and at wons, di blood kon stop.
LESSON
Any pesin wey no dey well but trust God say hin go make am well go receive am. We wey be believer fit be di reason wey we go quick get healing because we believe oga God. We no fit say we believe oga God without say we get faith to receive healing,deliverance. We wey bi oga God pikin must get di deliverance wey we nid in di spirit mind and to dey claim am. If God kon see di effort wey we take, he go kon use him power give am to us wetin we want. To talk am well-well, faith wey dey kampe go allow God pikin joli over every thing wey hin dey do fo hin life.
PRAYER
Oga God, abeg kon teach me how i go fit dey work in di faith wey i get, kon help me to put my faith to work, make i dey use my faith well-well so igo turn to blessing fo me. I dey talk am say in di name of oga Jesus krist make all sickness komot, i komot sickness, depression, poverty fo my life, i kon talk am say i don get oga God healing and deliverance in di name of oga Jesus krist, i no dey unda satan mago-mago again, i don win satan and i go win am forever wit di name of oga Jesus krist wey bi our God. AMEN
