Dey Watchful To Reject False Doctrines
Apostle Paul encourage Thessalonians to hold firm for dem traditional Christian belief wer heaven required. Paul say,
“Therefore, brethren, stand fast and hold the traditions wer dey taught you, whether by word or our epistle” (2 Thessalonians. 2:15).
LESSON:
Di beauty of Christianity na to stand firm in faith wer dey root in the holy bible. Christian suppose dey careful not to entertain false teachings - which lack bases for bible. No matter how interesting a teaching go sound, no one suppose entertain am- unless E go validate with the bible. Also, children of God most also dey careful not to go mistake every rhetorical rendition as di true word of God.
PRAYER:
Dear God, Abeg keep my feet from falling but help me so I go hold firm for him teaching wer you donvalidate for bible. No lemme become complacent with your word but help me to abide by your instructions so I go fit prosper. Give me the gift of discernment of spirit so I fit hold firm to the truth always. For in the name of Jesus Christ na him I make my request. Amen.
