Dey Honor Di Savants Of Oga God By Providing Dia Nids
Di savants of Oga God dey hold special place insaid di mind of Oga God,and we suppose konsider dem special also. Paul talk am how impotant e dey to dey kare fo God servants need and say,
“Yu no know say dose who minista di holy tins dey eat from di tins of di temple, and dose wey serve at di altar get potion of the offerin of di altar? Even di Lord don kommand say dose wey dey preach di gospel most to dey live from di gospel” (1 Corinthians 9:13-14).
LESSON:
Courtesy want say make we take good kare of di savant of Oga God wey dey work ova our souls. Oga God savant dey pray kon dey fast join for our sake. Dem dey also find di face of Oga God so dem go fit dey fid us wit di word of Oga God - wey be di bread of life. Oga God savant dey represent Oga God, and we most to dey respect dem. Di rule of di thumb tok say any honor wey we give di savant of Oga God na wetin we dey give oga God hinsef. So, we bilivas most use evri chance wey we get to dey minista into di lives of di spiritual ledas wey dey our side.
PRAYER:
Oga God, I ondastand say gospel ministas na your ambassadors on earth; now, kon give me di grace to dey honor dem. Kon give me pawa to do evritin wey dey my pawa to minista in dea needs, kon let me be source of kourage to dea familis. I also pray join say make you give all your servants peace and joy so dat dem go kontinue to dey do your good works fo humanity and fo your kindom. Na fo Oga Jesus Krist name i beg all dis. Amen
