Christians Are Called To Live Exemplary Lifestyle
Paul call Philemon a brother, and he appreciate am fo sey hin be good steward of Oga Jesus Krist. Paul say,
“I thank my God, as i dey mention you in my prayer always,as i dey hear about your love and faith weh you get toward Oga Lord Jesus and toward all di saints, so that di sharing of your faith fit dey effective by acknowledgment of all di good thing weh dey inside you inside Krist Jesus. Fo we have great joy and consolation in your love, because di saints hearts don dey refresh by you, brother” (Philemon 1:4-7).
LESSON:
Kristians suppose Jesus Krist good steward. We suppose live exemplary lifestyle weh go challenge unbelievers to venture to become kristians also. Kristians must dey full of faith; we must dey reflective of Oga Jesus karakta to all aspects of life. As krist ambassador fo earth, selfish, pride heart, immorality, and all other ungodly behavior
Na must sey,e no suppose dey with us. Our live must dey full of grace God grace, and we must ensure sey God name dey praise fo every circumstance of our life.
PRAYER:
Dear God, I beg help me to be kristian weh dey live exemplary lifestyle weh other pipu fit emulate. Help me make i be your good steward; make me dey reflective fo you fo speech and fo things weh i dey do. Empawa me with your Holy Spirit make i live acceptable lifestyle before you always, so that i fit dey qualify to received your eternal rewards fo heaven. For in Oga Jesus Krist name imake my requests. Amen.
