Challenges No Go Dey Permanent
No pesin must to dey see repentans as say pesin no get korage; na sign sey pesin get strength and na symbol of humility! Pipu wey dey humble are dose wey no dey ashamed of dea sins to repent from dem. Pipu wey repent from dea sins are dose weh get korage. Dem prove sey dem dey honest and show sey dem dey depend on Oga God to help dem ovacome temptasons wey go kom leta. One profet fo di bible be example of dis. He konfes hin progressive stand wit God, and deklare hin hope fo a viktorious future. Di profet tok say, “So my enemies, make una nor happy, bikos of mi! Bikos wen ever I fall, I go raiz-up again. Even doh I dey fo darkness, Oga God go bi my light. I go dey patient as God dey punish mi, bikos I don sin against am. But afta E don ponish mi, E go fight fo mi kon make mi win. God go take mi enter di light and I go si en raitiousness.” (Micah 7:8-9).
LESSON
True humility touches di heart of God. He loves weh dey humble enough to confess dea sins and repent from dem. Meanwhile, God hates people who stubbornly hold on to dea sins. Di bible emphasized, “God resists di proud, but gives grace to di humble” (James 4:6). So, shidren of God must to ondastand di meaning of repentans and how dem go work on am. Biliva wey don dey insaid sin shud repent from am so dat dem go receive God forgiveness and restorason.
PRAYER
Oga God, I bi sinner, and dey very sorry fo my sins. I understand sey you bi loving and forgiving God; therefore, I ask fo your forgiveness. Abeg forgive me my sins wey I don sin before kon give me back di joy of your salvason! Kon give me pawa thru your Holy Spirit to live life wey dey pure and acceptable before you so dat I go fit enta your life wey no dey finish kindom. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
