Belivas must to dey preach di true gospel evritym
Oga Jesus krist vex fo di Pharisees fo dea mago-mago behaviour, he talk say; “Una wey bi Farisee pipu dey wosh outside cup and plate, but inside una belle, long-trot and wikedness full am. Una bi fool! Nor bi God wey make di outside still make inside? But make una from una heart give to pipu wey nor get, so dat evritin go dey klean fo una. “Curse dey una head! Una wey bi Farisee pipu! Una dey give God one out of evry ten tins wey una get! But una dey forget pipu wey nor get. “Curse dey una head! Una wey bi Farisee pipu! Una dey won sidan fo betta chair fo sinagog and una dey like make pipu dey greet una fo market. “Curse dey una head! Una bi like grave wey pipu dey mash pass and dem nor know sey na grave.” (Luke 11:39-44).
LESSON
Becos message wey bin from di cross (gospel) no dey sweet pipu no mean say we belivas no go dey preach am becos dey to safe human souls. Jehovah no send oga Jesus kon dis world to come dey tell us wetin go dey sweet us but he send am make hin kon tell us wetin we must do so we go receive di kindom of God. From now, pipu must dey respect di gospel and dey celebrate am even say hin no dey sweet us! Kristens must dey preach konfam Kristenity wey mago-mago no dey.
Belivas must to dey teach and preach wetin dey di bible so he go challenge pipu to dey obey God law so dem go dey fit fo hin kindom. our preaching no sopos bi say we won make pipu like us or becos say we won make pipu dey honor us, we must to dey preach God's truth as di holy spirit dey teach us. We must to let pipu know say na only through oga Jesus krist we fit get life wey no dey finish. No one go enter hin kindom only say hin don talk and accept oga Jesus krist as hin own savior
PRAYER
God abeg, kon make me beta Kristen who go dey obey evritin wey you talk and dey preach your gospel so i go fit win pipu fo your kindom. No let me dey tink of how i go kolet pipu praise or honor fo myself, kon give me pawa through di holy spirit so i go dey share di gospel in a way wey go make di sinners come to you. Kon help me so anitin wey i do go dey di same wit wetin dey fo di bible so i go fit enta your kindom, abeg kon make my effort favor your kindom so wetin oga Jesus krist kon do on eart no go go just laidat. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
