Believers Go Receive Dia Rewod For Heaven
Paul and Silas enta yawa bekos dey preach di gospel im Phillipi. Di phillipi pipol arrest kon beat dem witout say dem go thru legal process Dey tie dem wit chains kin throw dem for prisons. Howeva, do two remain kanpe in dia faith. Dey praised God in dia terrible situeasans, and sumtin wey big happen immediately. Di skripture talk am,
“Wen mid-nite rish, Paul and Silas kon dey pray and sing song give God and all di pipol wey dey di prison dey listin to dem. At wons, di groun start to shake, sotey all di wall and pilas wey dey di prison kon dey shake too. Na wons di door open and di shains wey dem take hook di pipol wey dey di prison, kon luz.” (Acts 16:25-26).
Na wetin hapun kause di prison chief guard make he give him life to Oga Jesus Krist.
LESSON:
Persecution cannot quench the fire of gospel. Anti gospel people may try to persecute Christians but they cannot prevail! God’s children are not ordinary, they have been endued with grace and power from heaven to do exploit and also go extra miles for the sake of God’s kingdom. Di Holy Spirit of God dey give bilivas pawa kin help dem to win ova crisis. Since, bilivas get plenti pawa, dem no sopos to dey fear terror of any kind. Instead, make dem stand gidigba wit dia konfeson of Oga Jesus Krist kon remain kanpe to di end. No mata how hard di situesan be, Oga Jesus Krist don promise di christian viktory.
Di savior tok say “I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world” (John 16:33).
PRAYER
Oga God, abeg give me grace to dey kanpe in faith. Let your Holy Spirit give me pawa to stay kanpe to ovakom trials and temptasons. Let me sing songs of viktory, and let your testimoni neva leave my life. At di end of my journey for dis eart, let me hear your voice for heaven” Welkom my good savant”. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen
