A Person Of Charitable Heart Will Enjoy God
Nehemiah hear about di uncomfortable situation of Israelites (hin pipu), and he dey sad. Hin noble cities (including Jerusalem) and dea pipu weh dey live dea dey in distress. The news caused Nehemiah to pray and fast fo God intervention. Di Bible report am, “....Hanani one of my brethren come with men from Judah; and I asked dem koncerning di Jews weh don escape, weh don survive di kaptivity, and koncerning Jerusalem. And dem say to me, “Di survivors weh remain from di captivity fo di province bi dea inside great distress and reproach. Jerusalem wall also break down, and hin gates burn with fire.” So nah, when I hear these words, that i sit down and cry, and mourn fo many days; I dey fast and pray before God of heaven” (Nehemiah 1:2-4). God respond to Nehemiah request and grant am grace before a gentile king to return home to rebuild hin homeland.
LESSON
God loves pipu weh help others. He greatly delights in pesin weh seeks good welfare of others. Jehovah go bless and honor such pesin and ensure he (or she) no see shame. Pipu weh dey kind and graceful towards others go get dea face beautified with wonderful rewards. Although dem fit get dea brief moment of hardship fo earth but dem go ultimately prevail. Jehovah go lift up kindhearted pipu so that dem fit be encouraged fo dea good work. One pesin of charitable mind go enjoy God benefits fo this life and di one weh dey come. Dea succeeding generations go also reap good rewards fo dea labor! No good thing go be found wanting fo one pesin weh hin mind fully kommitted to God and fully represent Oga Jesus Krist fo other pipu lives. God go honor dem always.
PRAYER
Dear God, i beg give me mind weh care and help other pipu. Make me to be part of another pesin solution. Make you give me grace to make positive kontributions to other pipu lives. Make me be problem solver and nobi problem kontributor! Enable me with grace to be your true ambassador on earth, so that your name fit be praised in the land of the living. (I beg address my own personal problems also so that i fit get more reasons to serve you). Fo in Oga Jesus Krist nake i make my requests. Amen.
