A Biliva Most To Dey Discipline
Jeremiah enta problem bekos he talk di mind of God. The government and religion ledas arrest am fo telling dem say make dem leave evil or dem go face di Konsequence. Di bible talk sey, “So, as I just talk finish, dem kon seize mi dey shaut, “We suppose kill you, bikos of dis rubbish wey you dey talk so! Wetin make you dey talk all dis foolish things with God name? Wetin make you dey talk with En name sey, ‘Dem go distroy dis temple, just as dem distroy Shiloh and nobody go dey here again.’ ” Den all di pipu kon gada round me.” (Jeremiah 26:8-9).
LESSON
Pipu wey no dey honest no like make dem dey konfront dem, and dem go like make dem stay fo dea sins. On di oda hand, honest pipu like godly korreson, so dem go fit prospa. Dose wey hate godly konfrontason and no go move to do korreson be proud. Dey see tins with dea own eyes only, and dem dey sin to suit dea selfish interest. God hate pesin wey dey proud. He no like pipu wey no dey think of korreson, and make necessary improvement.
Shidren of God must dey kareful so dem no go fall fo dis kategory. We must dey storbon to sin, but dey accept korreson, and dey willing to shange weneva we dey konfronted with our sins . We must take to God korreson and instroson fo di bible. We must also yield weneva we dey shallenged through oda medium – whether through preaching or face to face. Jehovah go honor us if we dey soft fo Hin hands Hin divine blessing go stay with pipu wey behave like sheep in di hands of dea masta!
PRAYER
Oga God, abeg make me a honest and a humble person wey dey bendable in your hands. Let me dey korretabkle! Discipline my flesh to dey follow your instruction wey dey inside di bible. Also, help me to dey listen to your instructions which may be pass through oda media, do with that one i go fit prospa on eart and make am to heaven.
Abeg give me grace to keep serving you akordin to wetin you dey expect .Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
