Always Exercise Faith
Some bible patriarchs make unpopular decision through faith - against dea society opinion, Even with that one dem no dey shame. God support dea decisions and honor dem, and He turn dem to become uncommon champions. Fo instance,
“With faith Moses, when hin grow up, he refuse to be call di pikin of Pharaoh daughter, instead e choose to suffer affliction with di people of God pass to dey enjoy di passing pleasures inside sin, esteeming di reproach of Krist greater riches pass di treasures weh dey Egypt; fo hin look to di reward. By faith hin forsake Egypt, e no fear di wrath of di king; Because hin endure as e see Him weh dey invisible. By faith hin keep di Passover and di sprinkling of blood, lest Him weh destroy di firstborn make he tosh dem. By faith dem pass through di Red Sea as by dry land, whereas di Egyptians, attempt to do so, dem drown” (Hebrews 11:24-29).
LESSON:
Believers must exercise faith ontop every situation of dea live. The need to exercise faith no fit over emphasize! Faith is what make kristianity meaningful; without am, we no dey different from gentiles. God na God of faith; believers must be people weh get faith also. We must live by faith, walk by faith, and to dey act in faith. Our faith exercise no go turn things around fo our advantage. With faith fo action, we go subdue mountains and level valleys. Faith go make us triumph in every situations, and we go have course to glorify God. Every child of God must get word of affirmation. Everyone kristian must be able to say "With God all things dey possible!"
PRAYER:
In di name of Jesus Krist, I profess my faith fo salvation. In Jesus Krist name, I proclaim my steadfast Kristianity. I go stand firm and no go fall from grace of di Lord. In di name of Jesus Krist I declare my victory over everi situation of life. By di authority of Jesus Krist I triumph over principalities and powers. I declare myself as a winner of all situation. I am a victor and i am a testimony. From today, doors of goodness, progress, and all greatness go be open fo me in every side. I shall prosper in whatever I lay my hands on. I shall prosper in the house, and I shall prosper in the field. I shall prosper in all my endeavors, and my song of testimony shall abide forever! Fo in di name of Jesus Krist i make all my declaration of faith. Amen!